That Tinubu Jujuman Sha. Abeg who get his number?
Fashola for 8 years he be governor, Tinubu share of taxes and property stolen under Fashola many pass Fashola wey be governor own. Na Tinubu get largest share for TVC and naim divide all that Ikosi, Ketu land that used to be a college of education. Fashola no fit even know names of delegates of APC and no fit choose his own successor.
Now Ambode, after three years, ordinary to finish his term he no fit. Ambode no fit make LG chairmen wey he dey divide money give every month make them loyal to am
Anyway, see me dey talk. Person no see trailer wey pass, I dey ask am the colour of shirt wey trailer driver wear. Them fit do bigname Fashola, who be Ambode.
My own na just to know the Tinubu jazzman. Who get he number? E get this emm… wey I want emm… just give me his number. I want know if na Mtn or Etisalat, no be say I want make he work for me. I am a Christian.
Ena Ofugara
Leave Your Comment